Friday, 21 November 2014

Hope Akpan Don Wounjur For 3 Months

Photo: London24
E don becom confamento tori say Naija sabi player Hope Akpan wey dey ball for Reading FC for England don get wounjur wey no go make am tap ball for 3 months.

Na for de 2-kondo match wey Naija  bin follow Congo play for Brazzaville na hin dem do de guyman dis strong tin. We dey get confam amebo say na dislocated shoulder shoulder be dis wounjur wey we dey yarn about.

Dis tori mean say Reading no go get dis guyman for dem squad so tey until February wey dem say hin wounjur go done finally.

De oga boss and coachito for hin club don dey sweat ontop say de Naija player no go dey for hin side dey tap ball till next year as hin don dey do am for dem since lass year.

Hin even tell amebo pipu say for de sake say Naija fit look Akpan side com call am enter Super Eagles squad mean say de guyman game don improve wella for de club.

Na for January 2013 Hope Akpan enter Reading from Crawley and de guyman just get hin 50th appearance for de English club.


Follow us for Twitter @ConfamSports

Thursday, 20 November 2014

Magomago Dey Inside Drogba Transfer To Chelsea


Chelsea sabi striker, Didier Drogba first transfer enter Chelsea from Marseille don cause serious gbege for France sake of say dem don arrest pipu dey ask dem qweshun since Tuesday.

Oga presido for Marseille, Vincent Labrune plus including two other presido wey don dey there before am, Jean-Claude Dassier and Pape Diouf, dey inside pipu wey police don dey do jamb for since sake of say wuruwuru dey inside commission and payment wey dem bin collect ontop Drogba head.

Diouf bin get hand inside de mata of hin tranfer from Guingamp enter Marseille for 2003, even when de Ivory Coast player transfer go Chelsea for pepper wey reach £24m.

No be only Drogba transfer dey cause katakata for Marseille right now, even Samir Nasir deal enter Arsenal for £15.8m enter Arsenal in 2008 sef get comma.

Even de oga presido wey dey for Marseille as e be right now, Christophe Bouchet don let all man know say hin go really surprise say hin former oga wey bin dey there before fit get hand for all de palava wey dey ground. Police investigation still dey shele ontop de transfer gbege sha.

Man United Dey Sweat Ontop Di Maria Wounjur

Photo: SL10

Manchester United sabi winger, Angel Di Maria don go use X-ray check hinsef for hospital after Nani clip am for leg for de International Padi-Padi match wey Portugal follow Argentina play yestaday for Old Trafford.

De Manyu record signing still bin dey tap ball dey go after de tackle before Gerardo Martino comot am for 60 minutes. Argentina coachie don make am confamento say Di Maria need go check hinsef for hospital, but de oga coachie let all man know say even if de sabi player wounjur e no go long wey hin go continue to dey tap ball again.


De former Madrid winger still dey get confido say hin go play against Arsenal for Saturday as hin take relate all hin fans for twitter yestaday evening.
Na like dis hin take write de tweet, "It was just a blow. I hope it does not swell anymore so I can play at the weekend."

Wednesday, 19 November 2014

No NPFL For Kwara United, Na Koboko Sure Pass

Photo: NigerianLeagues.com

De O&D committee for NFF don waya de Afonja Warriors koboko of 450,000 naira fine sake of say na dem cause de gbege wey shele for Kaduna during de match wey dem play wit Ranchers Bees for Week 30 fixture of Naija National League on Saturday.

De informate wey we bin get na say dem no finish de match, dem abandon am for 75 minutes wey de match don dey for 2-2 draw sake of say de Kaduna fans dem attack de match officials plus including de officials of Kwara United too. And say dem beat Kwara United camera man.

But wetin we con later dey hear from media officer of Ranchers Bees, Vincent Akinbami na say na ogbonge lie be dat one and na de official pipu for Kwara United cook de tori wit beta seasoning dem.

"Wetin de pipu for Kwara United do for dat match na small pikin tin o. You go even think say dem dey do film sef.

"Make una reason am wit me o, how e take possible make team wey don dey lose 2-kondo wey com later equalize go com talk say na to beat dem officials and seize camera na hin next to do?

"After we score we 2nd goal na so Kwara United officials run enter pitch dey claim say we fans attack dem. Later after dem abandon de match I see dem dey throw stone for we chairman, Abdulazeez Mohammed. All dis tins dem dey do just do provoke de Ranchers Bees fans ni," Akinbami yarn.

De ogbonge confamento informate wey we gather yestaday na say O&D Committee pipu for NFF don do dem investigation and police wolewole work wella and dem see say na from de Afonja Warriors de gbege start, na wetin make Dem fine Kwara United 450 thousand naira and dem dash Ranchers Bees 3 points wey make dem get graduation enter NPFL.


Na for Oyinbo Vincent Akinbami do de interview.

Tuesday, 18 November 2014

Caf Don Announce Candidates To Host AFCON For 2017

Photo: CAFonline

CAF don yarn all man informate ontop candidates dem who go host African Cup of Nations for 2017.

De pipu wey dem announce na Egypt, Algeria, Gabon plus including Ghana na countries wey tanda for line say dem wan host 2017 AFCON. CAF ja Kenya, Sudan and Zimbabwe comot sake of say dem no reach level of standard for CAF to host am.


CAF don bin dey find candidate wey go do replacement for Libya wey yarn say dem no do again sake of security and organisation gbege. Na wetin make CAF start to dey collect application again and dem don yarn say dem go relate all man ontop who go host am final final next year.

Monday, 17 November 2014

Dolphins No Go Sell Eduok For Pepper Way Small Pass N175M

Photo: The Herald

Naija Premier League club, Dolphins, don yarn any club wey wan buy Emem Eduok comot from de Port Harcourt club say dem go spend pepper wey reach N175 million, wey be One Million US dollars, ontop de sabi striker.

Oga General Manager for Dolphins, Joe Johnson, na hin yarn all man say na de correct amount wey any club wey wan sign de striker wey na knack 24 goals for all competition dis season go pay be dat.

"Price tag dey ontop Emem head and na big one. De padi padi match wey hin play for Naija against Ghana sef helep make hin price increase small.

"I no think say any player for Naija fit dey rock shoulder wit am now sef na de reason why we get plenty money like dat ontop hin head be dat. And I no think say 1 milla too much for am," Johnson relate.

De oga general manager yarn amebo pipu say de sabi striker worth every shishi of dey de 1 million dollars sake of say no be small tin hin do dis season.

"Wetin hin do dis season no be small tin at all. If you see am dey tap ball you see say hin really dey hung to dey play beta every time and to dey score plenty goals," na so Johnson yarn am.


Na for Oyinbo Joe Johnson do de interview.

Mfon Udoh Na Oga Boss For NPFL

Photo: SL10
Mfon Udoh of Enyimba International don end season as pesin wey get goal pass for one season as de Akwa Ibom man qwench de waka wit 23 goals. Hin use 3 goals pass Jude Aneke wey set de record befor befor for Kaduna United for 2011.
Na two times de guyman shake net to confam say Enyimba International qwalify enter next season CAF Champe League as dem take waya Kano Pillars wey don carry league cup since lass week 3-1.
Na sweet sweet goals wey dey totori man belle be de two goals wey Mfon score, especially de first one wey hin tear beta shot wey be like say de ball give de post upper cut. De second one na sake of defensive error from Kano Pillars defender as de former Akwa United man make am 2-kondo for Enyimba and 23 goals for hinsef dis season.