![]() |
Photo: SL10 |
De Manyu record signing still bin dey tap ball dey go after de tackle before Gerardo Martino comot am for 60 minutes. Argentina coachie don make am confamento say Di Maria need go check hinsef for hospital, but de oga coachie let all man know say even if de sabi player wounjur e no go long wey hin go continue to dey tap ball again.
De former Madrid winger still dey get confido say hin go play against Arsenal for Saturday as hin take relate all hin fans for twitter yestaday evening.
Na like dis hin take write de tweet, "It was just a blow. I hope it does not swell anymore so I can play at the weekend."
No comments:
Post a Comment