Friday, 19 December 2014

Uche Chook Biro For Paper For Villareal Again

Photo: Getty Images

Ikechukwu Uche don sign new two-year deal wey go keep am for Villareal till 2017.

De sabi striker wey be 30 years pikin now sign for de Yellow Submarines from Zaragoza for 2011 as dem loan am to Granada before dem collect am back to dey ball for dem.

De guyman sef dey joli say hin don sign new contract wit club wey hin like as hin take yarn am for twitter.


"I belle dey totori me for dis new contract wey I sign wit @Villareal until 2017," na so de sabi man drop am wit hin official doormot for twitter, @ikeuche9.
"I go do my best to helep de team," Uche write am.
*Na for Oyinbo Ikechukwu Uche write de tweet.
Make una no forget follow us for twitter: @ConfamSports

Sterling Na My Own Sanchez -Rodgers

Photo: Getty Images

Liverpool coachie, Brendan Rodgers don compare Liverpool sabi player Raheem Sterling wit Arsenal Alexis Sanchez.

Sterling shake net two times on Wednesday when Liverpool waya Bournemouth 3-1 take qualify enter semi-final of Capital One Cup wey dem go follow Chelsea wear one trouser.

Rodgers no waste time to hail de sabi player wey be 20 years pikin for hin beta beta contribution for Liverpool since.

"For dat position wey hin dey play, hin dey tap ball like how Sanchez dey do am for Arsenal," Rodgers relate.

"Hin no be we main striker for here but anytime wey ball dey hin leg hin dey cause kasala for any defense," Na so de coachie yarn am.

*Na for Oyinbo Brendan Rodgers do de interview

Make una no forget follow ontop twitter: @ConfamSports

Ronaldo Beta Pass Messi -Roberto Carlos

Photo: Getty Images

Former sabi player for Real Madrid and Brazil don open mouth yarn say na Cristiano Ronaldo suppose chop de de Ballon d'Or award instead of Lionel Messi of Barcelona.

Make una for remember say na Ororo (Ronaldo) win de award last year, 2013, sake of say na hin sabi pass for de year. And hin name dey de final three shortlist for pipu wey fit carry de award join body wit Lionel Messi and Germany sabi keeper, Manuel Neuer.

"E sure for me say na Ronaldo get dis award. Una see de way wey hin take dey score goals anyhow from last season. Dem suppose give am something for hin sabiness and na Ballon d'Or be de award for am", Carlos relate.

Make una no forget follow us for twitter: @ConfamSports