Monday, 17 November 2014

Dolphins No Go Sell Eduok For Pepper Way Small Pass N175M

Photo: The Herald

Naija Premier League club, Dolphins, don yarn any club wey wan buy Emem Eduok comot from de Port Harcourt club say dem go spend pepper wey reach N175 million, wey be One Million US dollars, ontop de sabi striker.

Oga General Manager for Dolphins, Joe Johnson, na hin yarn all man say na de correct amount wey any club wey wan sign de striker wey na knack 24 goals for all competition dis season go pay be dat.

"Price tag dey ontop Emem head and na big one. De padi padi match wey hin play for Naija against Ghana sef helep make hin price increase small.

"I no think say any player for Naija fit dey rock shoulder wit am now sef na de reason why we get plenty money like dat ontop hin head be dat. And I no think say 1 milla too much for am," Johnson relate.

De oga general manager yarn amebo pipu say de sabi striker worth every shishi of dey de 1 million dollars sake of say no be small tin hin do dis season.

"Wetin hin do dis season no be small tin at all. If you see am dey tap ball you see say hin really dey hung to dey play beta every time and to dey score plenty goals," na so Johnson yarn am.


Na for Oyinbo Joe Johnson do de interview.

Mfon Udoh Na Oga Boss For NPFL

Photo: SL10
Mfon Udoh of Enyimba International don end season as pesin wey get goal pass for one season as de Akwa Ibom man qwench de waka wit 23 goals. Hin use 3 goals pass Jude Aneke wey set de record befor befor for Kaduna United for 2011.
Na two times de guyman shake net to confam say Enyimba International qwalify enter next season CAF Champe League as dem take waya Kano Pillars wey don carry league cup since lass week 3-1.
Na sweet sweet goals wey dey totori man belle be de two goals wey Mfon score, especially de first one wey hin tear beta shot wey be like say de ball give de post upper cut. De second one na sake of defensive error from Kano Pillars defender as de former Akwa United man make am 2-kondo for Enyimba and 23 goals for hinsef dis season.