![]() |
Photo: SL10 |
Mfon Udoh of Enyimba International don end season as pesin wey get goal pass for one season as de Akwa Ibom man qwench de waka wit 23 goals. Hin use 3 goals pass Jude Aneke wey set de record befor befor for Kaduna United for 2011.
Na two times de guyman shake net to confam say Enyimba International qwalify enter next season CAF Champe League as dem take waya Kano Pillars wey don carry league cup since lass week 3-1.
Na sweet sweet goals wey dey totori man belle be de two goals wey Mfon score, especially de first one wey hin tear beta shot wey be like say de ball give de post upper cut. De second one na sake of defensive error from Kano Pillars defender as de former Akwa United man make am 2-kondo for Enyimba and 23 goals for hinsef dis season.
No comments:
Post a Comment