Tuesday, 25 November 2014

UEFA Champe: PSG, Barca, Chelsea Confam Dem Qualify Enter Next Level


PSG, Barcelona plus including Chelsea of England join body wit clubs wey don qualify comot for group stage for UEFA Champe matches dem wey shele yestaday.

Na 8 matches dem play all over Europe yestaday night and dem score 28 goals. And na for inside dat 28 Messi hat-trick wey hin use break record of pesin wey tear net pass for Champe dey inside.

GROUP E:
Oya make we start for group E, Sergio Aguero na de oga boss for Manchester City as hin save dem head. If no be hin hat-trick wey hin score against Bayern Munich e for just be say dem come Champe com mark register dis season. Na from 2-1 wey Bayern dey lead Man City take over take dem win de match yestaday 3-2 for Etihad stadium. Na Xabi Alonso, wey dey celebrate hin 33 baiday, and Lewandowski score for Bayern.

Na from de first match of de group God don dey helep City as CSKA Moscow equalize 1-1 for last minute for dem match against Roma. If to say Roma win dat match na freedom ceremony we for dey do now for Man City for dat group.

So as e be for Group E now, Bayern Munich don qualify tey tey wit 12 points and de rest of clubs wey dey there get 5 points.

GROUP F:
PSG confam dem place for knock out stage as dem kpokpo Ajax 3-1. Na Edin Cavani and Zlatan Ibrahimovic do Ajax dis strong tin. Cavani score two times.

Na beta congratulobia go dey shele for inside Barca camp as we dey becos of all de shelement yestaday night for de match wey dem play APOEL Nicosia. Messi hat-trick make am break another record for inside 4 days and Luis Suarez do naming ceremony of goal when hin tear net for de first time for Barca. 4-kondo na de final scores.

So PSG na de oga boss for dis group wit 13 points as Barca follow dem wit 12 points as two of dem mark register for next level of Champe.

GROUP G:
Na correct swagger Chelsea use qualify dem own enter next level as dem waya Schalke anyhow. Dem almost spell Schalke name wit de 5-kondo wey dem use win.
Dat result confam Chelsea for knock out stage.

Sporting CP climb go 2nd for group as dem flog Maribor 3-1 for dem own match wey NEPA wan pour sand-sand for dem garri for half time.

GROUP H:
Na ordinary ceremony match na hin dem play for Group H yestaday sake of say FC Porto and Shakhtar Donetsk don qualify comot for dat group. But Shakhtar still manage lose to Athletic Bilbao 1-kondo for inside dem backyard.

FC Porto no even pity BATE Borisov for dem own match as dem kpokpo de Belarus club 3-kondo for inside dem house.


*Make una no forget follow us for twitter: @ConfamSports

Boboye Na De Tear Rubber Sunshine Stars Coachie

Photo: SL10

De ogas dem for Sunshine Stars of Akure no gree waste time at all do replacement sharpaly for dem caochie wey carry dem end for 11 for Naija Professional Football League wey just finish. Hin name na Eramus Onuh.

Na only 4 months Eranus Onuh use wit de Akure Gunners befor hin contract expire. And de guyman fit don dey hope say dem go chook biro for paper again extend am but de management pipu for Sunshine talk say "mbanu".


According to confamento amebo from Akure, de weight wey dem carry put for Boboye shoulder now na say make hin redeem de Akure club image for next season.
Boboye start last season as coachie for Sunshine Queens wey tap ball for Federation Cup final befor hin later finish de season for Rising Stars.

*Make una no forget follow us for twitter: @ConfamSports

Chai! Keshi Na Untouchable Fire o


Pesin wey naked no fit chook hand for pocket o. Keshi think say say combat jeans plus including jungle jacket hin dey wear when be say na only boxers and singlet de guyman dey wear.

And de coachie don even turn fire wey nobody fit touch sef. We dey get confamento amebo from NFF say dem no fit sack de man sake of say na we oga presido for Naija, Goodluck Jona, carry de man put back for de driver seat as hin no gree drive Naija enter Equatorial Guinea.

Una fit remember say NFF pipu don throway dis man befor like wash hand water but we presido say make dem please give am de job back.

As e be now e sure say na fear from above dey do de NFF pipu since Naija never qualify for AFCON 2015. Even NFF prsido, Amaju Pinnick bin talk say hin get plan to carry de Super Eagles job give oyinbo man but de oga never really even talk ontop de matter since, but all man know say na wetin dey dem mind be dat.


Na only God fit helep football for Naija from hand of God fatherism.


*Make una no forget follow us for twitter: @ConfamSports