Na 8 matches dem play all over Europe yestaday night and dem score 28 goals. And na for inside dat 28 Messi hat-trick wey hin use break record of pesin wey tear net pass for Champe dey inside.
GROUP E:
Oya make we start for group E, Sergio Aguero na de oga boss for Manchester City as hin save dem head. If no be hin hat-trick wey hin score against Bayern Munich e for just be say dem come Champe com mark register dis season. Na from 2-1 wey Bayern dey lead Man City take over take dem win de match yestaday 3-2 for Etihad stadium. Na Xabi Alonso, wey dey celebrate hin 33 baiday, and Lewandowski score for Bayern.
Na from de first match of de group God don dey helep City as CSKA Moscow equalize 1-1 for last minute for dem match against Roma. If to say Roma win dat match na freedom ceremony we for dey do now for Man City for dat group.
So as e be for Group E now, Bayern Munich don qualify tey tey wit 12 points and de rest of clubs wey dey there get 5 points.
GROUP F:
PSG confam dem place for knock out stage as dem kpokpo Ajax 3-1. Na Edin Cavani and Zlatan Ibrahimovic do Ajax dis strong tin. Cavani score two times.
Na beta congratulobia go dey shele for inside Barca camp as we dey becos of all de shelement yestaday night for de match wey dem play APOEL Nicosia. Messi hat-trick make am break another record for inside 4 days and Luis Suarez do naming ceremony of goal when hin tear net for de first time for Barca. 4-kondo na de final scores.
So PSG na de oga boss for dis group wit 13 points as Barca follow dem wit 12 points as two of dem mark register for next level of Champe.
GROUP G:
Na correct swagger Chelsea use qualify dem own enter next level as dem waya Schalke anyhow. Dem almost spell Schalke name wit de 5-kondo wey dem use win.
Dat result confam Chelsea for knock out stage.
Sporting CP climb go 2nd for group as dem flog Maribor 3-1 for dem own match wey NEPA wan pour sand-sand for dem garri for half time.
GROUP H:
Na ordinary ceremony match na hin dem play for Group H yestaday sake of say FC Porto and Shakhtar Donetsk don qualify comot for dat group. But Shakhtar still manage lose to Athletic Bilbao 1-kondo for inside dem backyard.
FC Porto no even pity BATE Borisov for dem own match as dem kpokpo de Belarus club 3-kondo for inside dem house.
*Make una no forget follow us for twitter: @ConfamSports
No comments:
Post a Comment