Showing posts with label Oyinbo Football. Show all posts
Showing posts with label Oyinbo Football. Show all posts

Tuesday, 25 November 2014

UEFA Champe: PSG, Barca, Chelsea Confam Dem Qualify Enter Next Level


PSG, Barcelona plus including Chelsea of England join body wit clubs wey don qualify comot for group stage for UEFA Champe matches dem wey shele yestaday.

Na 8 matches dem play all over Europe yestaday night and dem score 28 goals. And na for inside dat 28 Messi hat-trick wey hin use break record of pesin wey tear net pass for Champe dey inside.

GROUP E:
Oya make we start for group E, Sergio Aguero na de oga boss for Manchester City as hin save dem head. If no be hin hat-trick wey hin score against Bayern Munich e for just be say dem come Champe com mark register dis season. Na from 2-1 wey Bayern dey lead Man City take over take dem win de match yestaday 3-2 for Etihad stadium. Na Xabi Alonso, wey dey celebrate hin 33 baiday, and Lewandowski score for Bayern.

Na from de first match of de group God don dey helep City as CSKA Moscow equalize 1-1 for last minute for dem match against Roma. If to say Roma win dat match na freedom ceremony we for dey do now for Man City for dat group.

So as e be for Group E now, Bayern Munich don qualify tey tey wit 12 points and de rest of clubs wey dey there get 5 points.

GROUP F:
PSG confam dem place for knock out stage as dem kpokpo Ajax 3-1. Na Edin Cavani and Zlatan Ibrahimovic do Ajax dis strong tin. Cavani score two times.

Na beta congratulobia go dey shele for inside Barca camp as we dey becos of all de shelement yestaday night for de match wey dem play APOEL Nicosia. Messi hat-trick make am break another record for inside 4 days and Luis Suarez do naming ceremony of goal when hin tear net for de first time for Barca. 4-kondo na de final scores.

So PSG na de oga boss for dis group wit 13 points as Barca follow dem wit 12 points as two of dem mark register for next level of Champe.

GROUP G:
Na correct swagger Chelsea use qualify dem own enter next level as dem waya Schalke anyhow. Dem almost spell Schalke name wit de 5-kondo wey dem use win.
Dat result confam Chelsea for knock out stage.

Sporting CP climb go 2nd for group as dem flog Maribor 3-1 for dem own match wey NEPA wan pour sand-sand for dem garri for half time.

GROUP H:
Na ordinary ceremony match na hin dem play for Group H yestaday sake of say FC Porto and Shakhtar Donetsk don qualify comot for dat group. But Shakhtar still manage lose to Athletic Bilbao 1-kondo for inside dem backyard.

FC Porto no even pity BATE Borisov for dem own match as dem kpokpo de Belarus club 3-kondo for inside dem house.


*Make una no forget follow us for twitter: @ConfamSports

Thursday, 20 November 2014

Magomago Dey Inside Drogba Transfer To Chelsea


Chelsea sabi striker, Didier Drogba first transfer enter Chelsea from Marseille don cause serious gbege for France sake of say dem don arrest pipu dey ask dem qweshun since Tuesday.

Oga presido for Marseille, Vincent Labrune plus including two other presido wey don dey there before am, Jean-Claude Dassier and Pape Diouf, dey inside pipu wey police don dey do jamb for since sake of say wuruwuru dey inside commission and payment wey dem bin collect ontop Drogba head.

Diouf bin get hand inside de mata of hin tranfer from Guingamp enter Marseille for 2003, even when de Ivory Coast player transfer go Chelsea for pepper wey reach £24m.

No be only Drogba transfer dey cause katakata for Marseille right now, even Samir Nasir deal enter Arsenal for £15.8m enter Arsenal in 2008 sef get comma.

Even de oga presido wey dey for Marseille as e be right now, Christophe Bouchet don let all man know say hin go really surprise say hin former oga wey bin dey there before fit get hand for all de palava wey dey ground. Police investigation still dey shele ontop de transfer gbege sha.

Man United Dey Sweat Ontop Di Maria Wounjur

Photo: SL10

Manchester United sabi winger, Angel Di Maria don go use X-ray check hinsef for hospital after Nani clip am for leg for de International Padi-Padi match wey Portugal follow Argentina play yestaday for Old Trafford.

De Manyu record signing still bin dey tap ball dey go after de tackle before Gerardo Martino comot am for 60 minutes. Argentina coachie don make am confamento say Di Maria need go check hinsef for hospital, but de oga coachie let all man know say even if de sabi player wounjur e no go long wey hin go continue to dey tap ball again.


De former Madrid winger still dey get confido say hin go play against Arsenal for Saturday as hin take relate all hin fans for twitter yestaday evening.
Na like dis hin take write de tweet, "It was just a blow. I hope it does not swell anymore so I can play at the weekend."