Thursday, 20 November 2014

Magomago Dey Inside Drogba Transfer To Chelsea


Chelsea sabi striker, Didier Drogba first transfer enter Chelsea from Marseille don cause serious gbege for France sake of say dem don arrest pipu dey ask dem qweshun since Tuesday.

Oga presido for Marseille, Vincent Labrune plus including two other presido wey don dey there before am, Jean-Claude Dassier and Pape Diouf, dey inside pipu wey police don dey do jamb for since sake of say wuruwuru dey inside commission and payment wey dem bin collect ontop Drogba head.

Diouf bin get hand inside de mata of hin tranfer from Guingamp enter Marseille for 2003, even when de Ivory Coast player transfer go Chelsea for pepper wey reach £24m.

No be only Drogba transfer dey cause katakata for Marseille right now, even Samir Nasir deal enter Arsenal for £15.8m enter Arsenal in 2008 sef get comma.

Even de oga presido wey dey for Marseille as e be right now, Christophe Bouchet don let all man know say hin go really surprise say hin former oga wey bin dey there before fit get hand for all de palava wey dey ground. Police investigation still dey shele ontop de transfer gbege sha.

No comments:

Post a Comment