![]() |
Photo: London24 |
Na for de 2-kondo match wey Naija bin follow Congo play for Brazzaville na hin dem do de guyman dis strong tin. We dey get confam amebo say na dislocated shoulder shoulder be dis wounjur wey we dey yarn about.
Dis tori mean say Reading no go get dis guyman for dem squad so tey until February wey dem say hin wounjur go done finally.
De oga boss and coachito for hin club don dey sweat ontop say de Naija player no go dey for hin side dey tap ball till next year as hin don dey do am for dem since lass year.
Hin even tell amebo pipu say for de sake say Naija fit look Akpan side com call am enter Super Eagles squad mean say de guyman game don improve wella for de club.
Na for January 2013 Hope Akpan enter Reading from Crawley and de guyman just get hin 50th appearance for de English club.
Follow us for Twitter @ConfamSports