Tuesday, 18 November 2014

Caf Don Announce Candidates To Host AFCON For 2017

Photo: CAFonline

CAF don yarn all man informate ontop candidates dem who go host African Cup of Nations for 2017.

De pipu wey dem announce na Egypt, Algeria, Gabon plus including Ghana na countries wey tanda for line say dem wan host 2017 AFCON. CAF ja Kenya, Sudan and Zimbabwe comot sake of say dem no reach level of standard for CAF to host am.


CAF don bin dey find candidate wey go do replacement for Libya wey yarn say dem no do again sake of security and organisation gbege. Na wetin make CAF start to dey collect application again and dem don yarn say dem go relate all man ontop who go host am final final next year.

No comments:

Post a Comment