Friday, 19 December 2014

Uche Chook Biro For Paper For Villareal Again

Photo: Getty Images

Ikechukwu Uche don sign new two-year deal wey go keep am for Villareal till 2017.

De sabi striker wey be 30 years pikin now sign for de Yellow Submarines from Zaragoza for 2011 as dem loan am to Granada before dem collect am back to dey ball for dem.

De guyman sef dey joli say hin don sign new contract wit club wey hin like as hin take yarn am for twitter.


"I belle dey totori me for dis new contract wey I sign wit @Villareal until 2017," na so de sabi man drop am wit hin official doormot for twitter, @ikeuche9.
"I go do my best to helep de team," Uche write am.
*Na for Oyinbo Ikechukwu Uche write de tweet.
Make una no forget follow us for twitter: @ConfamSports

Sterling Na My Own Sanchez -Rodgers

Photo: Getty Images

Liverpool coachie, Brendan Rodgers don compare Liverpool sabi player Raheem Sterling wit Arsenal Alexis Sanchez.

Sterling shake net two times on Wednesday when Liverpool waya Bournemouth 3-1 take qualify enter semi-final of Capital One Cup wey dem go follow Chelsea wear one trouser.

Rodgers no waste time to hail de sabi player wey be 20 years pikin for hin beta beta contribution for Liverpool since.

"For dat position wey hin dey play, hin dey tap ball like how Sanchez dey do am for Arsenal," Rodgers relate.

"Hin no be we main striker for here but anytime wey ball dey hin leg hin dey cause kasala for any defense," Na so de coachie yarn am.

*Na for Oyinbo Brendan Rodgers do de interview

Make una no forget follow ontop twitter: @ConfamSports

Ronaldo Beta Pass Messi -Roberto Carlos

Photo: Getty Images

Former sabi player for Real Madrid and Brazil don open mouth yarn say na Cristiano Ronaldo suppose chop de de Ballon d'Or award instead of Lionel Messi of Barcelona.

Make una for remember say na Ororo (Ronaldo) win de award last year, 2013, sake of say na hin sabi pass for de year. And hin name dey de final three shortlist for pipu wey fit carry de award join body wit Lionel Messi and Germany sabi keeper, Manuel Neuer.

"E sure for me say na Ronaldo get dis award. Una see de way wey hin take dey score goals anyhow from last season. Dem suppose give am something for hin sabiness and na Ballon d'Or be de award for am", Carlos relate.

Make una no forget follow us for twitter: @ConfamSports

Tuesday, 25 November 2014

UEFA Champe: PSG, Barca, Chelsea Confam Dem Qualify Enter Next Level


PSG, Barcelona plus including Chelsea of England join body wit clubs wey don qualify comot for group stage for UEFA Champe matches dem wey shele yestaday.

Na 8 matches dem play all over Europe yestaday night and dem score 28 goals. And na for inside dat 28 Messi hat-trick wey hin use break record of pesin wey tear net pass for Champe dey inside.

GROUP E:
Oya make we start for group E, Sergio Aguero na de oga boss for Manchester City as hin save dem head. If no be hin hat-trick wey hin score against Bayern Munich e for just be say dem come Champe com mark register dis season. Na from 2-1 wey Bayern dey lead Man City take over take dem win de match yestaday 3-2 for Etihad stadium. Na Xabi Alonso, wey dey celebrate hin 33 baiday, and Lewandowski score for Bayern.

Na from de first match of de group God don dey helep City as CSKA Moscow equalize 1-1 for last minute for dem match against Roma. If to say Roma win dat match na freedom ceremony we for dey do now for Man City for dat group.

So as e be for Group E now, Bayern Munich don qualify tey tey wit 12 points and de rest of clubs wey dey there get 5 points.

GROUP F:
PSG confam dem place for knock out stage as dem kpokpo Ajax 3-1. Na Edin Cavani and Zlatan Ibrahimovic do Ajax dis strong tin. Cavani score two times.

Na beta congratulobia go dey shele for inside Barca camp as we dey becos of all de shelement yestaday night for de match wey dem play APOEL Nicosia. Messi hat-trick make am break another record for inside 4 days and Luis Suarez do naming ceremony of goal when hin tear net for de first time for Barca. 4-kondo na de final scores.

So PSG na de oga boss for dis group wit 13 points as Barca follow dem wit 12 points as two of dem mark register for next level of Champe.

GROUP G:
Na correct swagger Chelsea use qualify dem own enter next level as dem waya Schalke anyhow. Dem almost spell Schalke name wit de 5-kondo wey dem use win.
Dat result confam Chelsea for knock out stage.

Sporting CP climb go 2nd for group as dem flog Maribor 3-1 for dem own match wey NEPA wan pour sand-sand for dem garri for half time.

GROUP H:
Na ordinary ceremony match na hin dem play for Group H yestaday sake of say FC Porto and Shakhtar Donetsk don qualify comot for dat group. But Shakhtar still manage lose to Athletic Bilbao 1-kondo for inside dem backyard.

FC Porto no even pity BATE Borisov for dem own match as dem kpokpo de Belarus club 3-kondo for inside dem house.


*Make una no forget follow us for twitter: @ConfamSports

Boboye Na De Tear Rubber Sunshine Stars Coachie

Photo: SL10

De ogas dem for Sunshine Stars of Akure no gree waste time at all do replacement sharpaly for dem caochie wey carry dem end for 11 for Naija Professional Football League wey just finish. Hin name na Eramus Onuh.

Na only 4 months Eranus Onuh use wit de Akure Gunners befor hin contract expire. And de guyman fit don dey hope say dem go chook biro for paper again extend am but de management pipu for Sunshine talk say "mbanu".


According to confamento amebo from Akure, de weight wey dem carry put for Boboye shoulder now na say make hin redeem de Akure club image for next season.
Boboye start last season as coachie for Sunshine Queens wey tap ball for Federation Cup final befor hin later finish de season for Rising Stars.

*Make una no forget follow us for twitter: @ConfamSports

Chai! Keshi Na Untouchable Fire o


Pesin wey naked no fit chook hand for pocket o. Keshi think say say combat jeans plus including jungle jacket hin dey wear when be say na only boxers and singlet de guyman dey wear.

And de coachie don even turn fire wey nobody fit touch sef. We dey get confamento amebo from NFF say dem no fit sack de man sake of say na we oga presido for Naija, Goodluck Jona, carry de man put back for de driver seat as hin no gree drive Naija enter Equatorial Guinea.

Una fit remember say NFF pipu don throway dis man befor like wash hand water but we presido say make dem please give am de job back.

As e be now e sure say na fear from above dey do de NFF pipu since Naija never qualify for AFCON 2015. Even NFF prsido, Amaju Pinnick bin talk say hin get plan to carry de Super Eagles job give oyinbo man but de oga never really even talk ontop de matter since, but all man know say na wetin dey dem mind be dat.


Na only God fit helep football for Naija from hand of God fatherism.


*Make una no forget follow us for twitter: @ConfamSports

Friday, 21 November 2014

Hope Akpan Don Wounjur For 3 Months

Photo: London24
E don becom confamento tori say Naija sabi player Hope Akpan wey dey ball for Reading FC for England don get wounjur wey no go make am tap ball for 3 months.

Na for de 2-kondo match wey Naija  bin follow Congo play for Brazzaville na hin dem do de guyman dis strong tin. We dey get confam amebo say na dislocated shoulder shoulder be dis wounjur wey we dey yarn about.

Dis tori mean say Reading no go get dis guyman for dem squad so tey until February wey dem say hin wounjur go done finally.

De oga boss and coachito for hin club don dey sweat ontop say de Naija player no go dey for hin side dey tap ball till next year as hin don dey do am for dem since lass year.

Hin even tell amebo pipu say for de sake say Naija fit look Akpan side com call am enter Super Eagles squad mean say de guyman game don improve wella for de club.

Na for January 2013 Hope Akpan enter Reading from Crawley and de guyman just get hin 50th appearance for de English club.


Follow us for Twitter @ConfamSports