Wolverhampton Wanderers wey dey tap ball for English Championship dey get longer throat for Newcastle sabi player, Sammy Ameobi.
Although Newcastle bin don dash de winger new 1-year contract make hin sign e be like say life for Newcastle don tire de Naija pikin.
According to amebo wey we don gather, other Premier League clubs dem like West Brom, Everton plus including Burnley sef dey eye de Befor-befor England youth player.
Ameobi dey among pipu wey Coachie of Super Eagles Stephen Keshi don yarn say hin go like make dem tap ball for Naija and de 23 years pikin go like get club wey hin go dey play for wella instead to dey sidon for bench.
E possible make Ameobi be free agent wen season quench but any club wey wan kolobi am go need settle Newcastle wit small pepper becos of hin age..
-Follow us for Twitter @PidginSports
No comments:
Post a Comment