Friday, 15 May 2015

NFF Bone Amokachi, Confam Salisu As Assistant Coachie For Eagles


Naija Football Federation don finish dem join body ontop who go dey helep Stephen Keshi for side as Assistant Coachie for de Super Eagles.

Oga Keshi release list of 26 players wey dey tap ball for Naija to com join am for camp for 2017 AFCON qualifiers wit Chad and NFF let all man see de list wit name of coachies dem wey go train dem ready for de match.
NFF even tweet am sef wit dem official twitter doormot (@thenff) say na Stephen Keshi be de Head Coachito, Assistant Coachito na Salisu Yusuf and de goalie coachie na Ike Shorunmu.
Salisu Yusuf na befor-befor Kano Pillars and Enyimba Int'l coachie and na hin be coachie for El Kanemi Warriors now.
As per amebo wey we don gather. Amokachi wey don sidon ontop de Assistant coachie chair since November 2011 don dey use style dey near FC Taraba to be dem coachie for dia.
Naija go follow Chad enter one trouser for Kaduna for June 13 for dem first match 2017 AFCON qualifier..

   -Make you follow us for Twitter @PidginSports

No comments:

Post a Comment