Oga Coachie of the Flying Eagles Manu Garba go today sonch all Naija name of players wey go tap ball for FIFA U20 World Cup wey dey shele for New Zealand.
De boys go follow Nurnberg U23 team tap ball for padi-padi match today and de coachie don yarn befor say hin go open mouth talk de players after de match.
Manu still dey wait Kelechi Iheanacho, Moses Simon and Isaac Success to join body wit other players wey dey camp now but as per amebo wey we don gather, Success get one small injury wey dey disturb am, meanwhilly, Iheanacho and Simon never fit leave dem club as dem never release dem.
Flying Eagles go follow Brazil tap ball for dia first match of the World Cup for Stadium Taranaki, New Plymouth for June 1.
-Follow us for Twitter @PidginSports
No comments:
Post a Comment