Thursday, 14 May 2015

NNL Don Get Confam Date To Start


After so many push-push of the Naija National League date oga bosses for management of de league don do join body(meeting) range date wey e go start as Saturday, 16 May 2015.


Na NNL Chairman, Chief Emeka yarn amebo pipu for Abuja yesterday after de join body(meeting) of board members.

Ontop de mata, anoda aproko as Pidgin Sports gather na say de Week 1 fixtures of de league go hot light fire as Kaduna United go dey set trap for Adamawa United wen dem visit for Ahmadu Bello Stadium.

Kogi United go wear one trouser wit Spotlight FC, Supreme Court of Abuja go pack dem kaya go meet Jigawa Golden Stars for Dutse, wen Plateau United go dey ready to chop Yobe Desert Warriors anyhow.

    -Follow us for Twitter: @PidginSports 

No comments:

Post a Comment