Naija Federation Cup for 2015 don start engine yesterday wit Round of 64 matches dem wey shele for matchday 1. De remaining matches dem for Round of 64 go shele today all over we obodo Naija.
No club be small pikin again for Naija o as dem waya Shooting Stars SC, Giwa FC and Sunshine Stars comot for de tournament. And na clubs wey no get leg enter NPFL do dem de strong tin.
For de only match wey de 2 clubs be NPFL pipu, Bayelsa United kpokpo Nembe City 3-kondo for Neros.
Heavy rain wey dey fall for Ibadan yesterday no gree de match between FRSC FC and Sharks FC finish as dem run enter house for 77 minutes but dem go finish de match today for 8am sha. Na kondo-kondo be de match wen dem leave am..
Na Full Results of Round of 64 (MatchDay 1) Be Dis:
Enyimba FC 3-0 Nasarawa Feeders[Walk-Over] (Oshogbo)
Cardinal FC 2-5 Remo Stars (Warri)
Junior Spotlight 1-4 Lobi Stars (Abuja)
Heartland FC 2-1 Bizi Cashless (Abuja)
Idah United 1-3 Spotlight FC (Jos)
Kurmi Market 1-3 BJ Foundation (Ilorin)
Kano Pillars 3-0 Zara FC (Gusau) - (Walk-Over)
Plateau United 1-0 Shooting Stars (Aba)
Akwa Starlets 1-2 Kwara United (Enugu)
ABU FC 1-1 Ajiroba FC (Lokoja) - (4-2) on penalties
Giwa FC 2-2 Kukuruku Dragons (Minna)-- (4-5 on penalties)
Kaduna United 1-1 Enugu Rangers (Lokoja) (7-8 on penalties)
Makwada Warriors 2-1 Jigawa Stars (Gombe)
Doma United 0-2 Jalingo FC (Bauchi)
Inter FC 1-2 Dolphins FC (Calabar)
Nembe City 0-3 Bayelsa United (Neros)
J. Atete 3-1 Sunshine Stars (Benin)
Christ Ambas. 1-2 Prime FC (Abeokuta)
FC Abuja 0-2 Wikki Tourists (Katsina)
El-Kanemi Babes 0-1 Abia Warriors. (Lafia)
FRSC FC 0-0 Sharks FC (Ibadan) [Abandon for 77 mins. 13 mins remain]
MatchDay 2 matches dem go shele today all over obodo Naija and na de fixtures dem be dis,
Thursday, May 14, 2015:
Nasarawa United v New Vision (Aba) - 4pm
Akwa United v Dallatu United (Abuja) - 4pm
Peacemaker FC v New Stars (Minna) - 1pm
Binani FC v Gateway FC (Abuja) - 1pm
El-Kanemi Warriors v Kwara Football Academy (Kaduna) – 4pm
Papilo FC v Gombe United (Makurdi) - 4pm
FC Taraba v Akampa United (Lokoja) - 4pm
Caliphate Warr. v Crown FC (Minna) - 4pm
Tornadoes Feeders v Shinkafi United (Kano) - 4pm
Gabros FC v Chuson FC (Owerri) - 4pm
No comments:
Post a Comment