Wednesday, 13 May 2015

Oga Keshi Go Do Naming Ceremony For 26 Home-Base Eagles For AFCON Qualifiers


Oga Coachie Stephen Keshi don yarn all man say hin wan start with Super Eagles of Naija exactly as hin take do am last time wey hin coach de team.


De Big Boss bin dey follow SuperSport.com relate when hin yarn say na becos hin range plenty players for inside we Naija League na wetin carry 2013 AFCON cup enter we land be dat and hin must do de same tin to bring us success again.

“We suppose go back to basics make we do wetin helep us carry AFCON for 2013 inside Southy.

“I wan make Naija pipu happy again so I must range ogbonge team wey go play beta for dem.

“E make sense like dat if we dey give we own pipu for we land de chance to tap ball for dem country so na why I go sonch 26 of dem invite make dem com show me dem swagger,” naso Keshi yarn for Oyinbo.

De coachie also tear ear for all players as hin yarn all man say na only players dem wey dey wear dem club jersey to tap ball for dem hin go use for Super Eagles say hin no ready to dey coach bench warmer again.

“I don yarn am befor say I no fit dey use pipu wey don get seat belt for bench for dem club again. If you wan tap ball for dis country you must dey play for dat club every week.

“Automatic jersey no dey for any player o. And anybody wey no fit dey give 120 percent for field I go throway am like wash hand water.

“We no fit use small eye look Chad o. Becos dem no be small pikin country at all. We must train well to helep us kpokpo dem as we want,” the coachie relate.

Na Group G of de 2017 AFCON qualifiers Super Eagle dey wit Egypt, Tanzania and Chad. De match wit Chad go shele for June 12.

*Na for Oyinbo Oga Keshi do de interview

   -Follow me for Twitter @BayoPsalm

No comments:

Post a Comment