De Under 20 team of Naija dey for Germany for 2015 U20 World Youth Champe training as dem kolobi de Under23 team of Hoffenheim waya dem 5-2.
Coachie Manu Garba introduce small pikin sabi striker, Taiwo Awoniyi for second half of de match but de guyman no look say time short o as hin still tear net with hat-trick.
Chidera Ezeh wey dey tap ball for Porto plus including Godwin Saviour no slack dem sef too as na dem first tear net befor Awoniyi com show hin swagger.
As we take range de amebo, Flying Eagles go still follow Nurnberg U23 wear one trouser on Friday, May 15.
Coachie Manu Garba go com yarn all Naija pikin players dem wey go make hin 20-man list for de World Cup.
De Eagles go play anoda padi padi match wit Freiburg U23 in Tuesday, May 19 before dem com pack dem kaya go New Zealand where de 2017 WYC go shele.
-Follow me for Twitter @BayoPsalm
No comments:
Post a Comment