Oga Stephen Keshi wey be befor befor Coachie for Super Eagles
of Naija don yarn all man dis early mormor say hin no go sign de new contract
wey NFF carry dash am sake of say hin no be slave.
De coachie don let all man know say all de ngbati
ngbati(clauses) wey dey ontop de contract don too much and e be like say na
slave NFF wan use am do, plus including say de money wey dem wan give am no do
am.
“I don yarn Pinnick last week say make dem find somtin do
about all the clauses wey dem pack put ontop de contract unless I no go sign
am. But de presido no gree hear my own na why I dey talk am now say I don carry
dem papers give dem back o,” Keshi relate.
When amebo pipu bin ask am say weda na money mata no make am
sign de contract becos money no make am sign befor sef, naso de coachie para
finish com open mouth yarn truth o.
“I no go lie, de money sef no reach me o. De tin too small
nah. I no be anybody boy boy. Amaju Pinnick wan turn me to hin slave finish ni?
Although I no go let una know how much wey dem put for de contract, but I just
wan let am know say I no be anybody slave,” naso Keshi yarn.
Dis one wey Keshi don yarn hin church mind so e be like say
Naija go find new coachie to come coach de Super Eagles and we don dey get
Claude Le Roy wey dey Congo and Herve Renard wey just carry AFCON for Ivory
Coast.
(Na for Oyinbo Oga Keshi relate)
*Na APRIL FOOL TORI OOOOOOOOOOOOOOOO! LWKMD!
*HAPPY NEW MONTH TO ALL OF UNA FROM BAYO PSALM & THE WHOLE CREW OF GIDI SPORTLIGHT. GOD BLESS ALL OF UNA!
*Na APRIL FOOL TORI OOOOOOOOOOOOOOOO! LWKMD!
*HAPPY NEW MONTH TO ALL OF UNA FROM BAYO PSALM & THE WHOLE CREW OF GIDI SPORTLIGHT. GOD BLESS ALL OF UNA!
No comments:
Post a Comment