Wednesday, 19 November 2014

No NPFL For Kwara United, Na Koboko Sure Pass

Photo: NigerianLeagues.com

De O&D committee for NFF don waya de Afonja Warriors koboko of 450,000 naira fine sake of say na dem cause de gbege wey shele for Kaduna during de match wey dem play wit Ranchers Bees for Week 30 fixture of Naija National League on Saturday.

De informate wey we bin get na say dem no finish de match, dem abandon am for 75 minutes wey de match don dey for 2-2 draw sake of say de Kaduna fans dem attack de match officials plus including de officials of Kwara United too. And say dem beat Kwara United camera man.

But wetin we con later dey hear from media officer of Ranchers Bees, Vincent Akinbami na say na ogbonge lie be dat one and na de official pipu for Kwara United cook de tori wit beta seasoning dem.

"Wetin de pipu for Kwara United do for dat match na small pikin tin o. You go even think say dem dey do film sef.

"Make una reason am wit me o, how e take possible make team wey don dey lose 2-kondo wey com later equalize go com talk say na to beat dem officials and seize camera na hin next to do?

"After we score we 2nd goal na so Kwara United officials run enter pitch dey claim say we fans attack dem. Later after dem abandon de match I see dem dey throw stone for we chairman, Abdulazeez Mohammed. All dis tins dem dey do just do provoke de Ranchers Bees fans ni," Akinbami yarn.

De ogbonge confamento informate wey we gather yestaday na say O&D Committee pipu for NFF don do dem investigation and police wolewole work wella and dem see say na from de Afonja Warriors de gbege start, na wetin make Dem fine Kwara United 450 thousand naira and dem dash Ranchers Bees 3 points wey make dem get graduation enter NPFL.


Na for Oyinbo Vincent Akinbami do de interview.

1 comment: